POEM: OGA PANEL BEATER by Habeeb Damilare Ajinifesin
Oga Panel Beater
Twale baba o, oga panel beater
I be hear say ur hand de transport pipu go hospita
Even as e be say engineering na ur discipline
U get one kain talent for face-disfiguring
Oga panel
I be even hear say u be painta
Say with blood,u fit paint woman face wella
Say like soaked garri
U fit increase fat for person bodi
<script async src="https://pagead2.googlesyndication.com/pagead/js/adsbygoogle.js?client=ca-pub-9394274132319072"
crossorigin="anonymous"></script>
<ins class="adsbygoogle"
style="display:block"
data-ad-format="fluid"
data-ad-layout-key="-ew-1c-3l-g+lo"
data-ad-client="ca-pub-9394274132319072"
data-ad-slot="1731218212"></ins>
<script>
(adsbygoogle = window.adsbygoogle || []).push({});
</script>Oga Panel
I be hear say u de box pass Bash Ali
Martial art and every fighting skills na all u sabi
Say where u de dem no born Anthony Joshua.
Amaka wey refuse ur call na small e remain make u kill her
Oga Panel
I hear say even Jennifer wey de manage for ur place
One night u con vex dismantle her face
Just say she no gree make u nak am
U paint her face, na every bodi de pity am
Oga Panel
No vex o i wan quick yarn something
why no kuku use dat talent for boxing
Instead to de beat beauty babes like rain
U fit kukuma de hit panel of muscles and train.
Habeeb Damilare Ajinifesin is a Nigerian poet,a native of Kwara state. He is an undergraduate of accountanncy in the university of science and applied management, Benin republic.

Comments
Post a Comment